Why you dey look me like that?
Wetin we tif wey you dey call us thieves?
When rain dey fall, we go dey under am.
When sun bake, na under am we go dey.
Yet you go dey talk say we no dey do anything.
When we kill thieves, you go dey say:
“Wetin dem do wey dem dey make iyanga.”
When thieves kill us, you go say:
“God catch dem.”
We collect 20 bucks for your hand
Because salary no gree come.
Na im you wan crucify us?
Wetin you dey do for people wey cause this wahala?
I mean those who dey use pen tif your money
For inside AC.
No be “good baba” you dey call them?
Shebi na award you dey carry give them?
Abi you wan tell me say you dey sleep
When judge dey send person wey poverty push
Go tif ₦500 to 5 years imprisonment.
And you celebrated thieves wey dey steal
Billions to 5 months imprisonment
If I be educated illetrate like you
I no go use sledge hammer take kill mosquito.
OJEDIRAN JOHN OLUFEMI
No comments:
Post a Comment